abeg i wan yan bcos dis wan don pass me and as i dey like so i don vex no be small for the level of idiostupidity wey still dey do my bros and sis wey dey out dere dey look for husband and wifey. abeg me i wan talk to all of una say una don dey craze no be small and the level of craze don reach new level dis days.Ok una no belife me abi ok i go dey take am small by small so de ones among u wey ya brain be like walnut go take understand say when truth dey jam una for face una no dey listen and when u hear am una go just blind. make i first clear my troat as frog still dey inside start for my sisters.
SISTERS
na una get am for the problem boku pass,why ebi like say una just like am say make man dey flog u like goat wey no wan hear word. wen una dey ya papa hin house ya mama no dey yan una say wen u giv pammy for free who wan go climb tree cut am down again idiots make una dey close leg una no dey hear den wen we drink pammy finis run una go dey cry say den use una. if una no get common sense (i 4get den don stop to dey sell am 4 market ) make i teach una small go pammy shop na taste u go shak for free no be the whol calabash. abeg which man u wan giv
pammy wey sweet make he taste wey no go buy jerrycan go hen.
number 2 una to dey do yanga and for dis wan wey we dey for now wen d yanga to much boku ogboge fish dey inside pot now we no need to dey luk far again na for de front of our nostril the nxt one dey abeg efen don dey rich d one wey we don even de look man so u hav to be reduction de yanga dey front. ah no say if u get am for gud man make u dey luk for support oh dat one make sure say u catch am wellwell make he no run go find another fish and if d one wey u get no gud lefted am go catch new one
henhen abeg a bin wan ask shey na all of una be mungu ni or wetin how una no go know when man don get wife if una neva know and una wan make i yan u call me at 1-800 I BE MUNGU and i go yan u idiot.
then the wan wey dey wey na ya friend man u dey chase abeg yan me how u wan sleep wen u catch am finis. na hin be say u no go get woman friend abi den mak i warn u dey watch ya male freinds self.shame on the one wey don get one pikn for father one dey look for pikn two go find single mugun lefted de one wey dey do hin job for house well
and finnallly if he neva marry u after two years abeg pack ya bag ready inside in book get on ya marks and go for either side.
BOBOS
na una vex me pass y una no dey yan yasef trutru if una wan stay happy make una realise suntins
1 all woman na prostitute diff be say house prostitute na wife,visitin one na girlfriend and de rest na ashewo
2 wen he dey do yanga lefted am wen hin see say u no dey he go come
3 why u dey find wife for church, na dis one vex me pass after she don donate all her pikin finis she com church look for man u sef con put hed na im be say u be rat wey no get sense( make una all help me call am MUGUN) if u wan identifydem no worry i go give u accident course no be crash one alone luk my number above and call me .
plenty still dey my chest but i go leave una with dis one open ya ear and ya eye dey see well well b4 u dive ok
Monday, 7 July 2008
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment